Quote:
|
Originally Posted by paj
...the one thing I found astonishing was how much they cost @ home!  A cousin of mine emailed me and told me she suspects one of her roomie's friends for unifasiti 'lifted' her handset when she go shower and needs a replacement...me thinking "haba...na how much phone go cost for Naija..equivalent of $25...$30?"  quickly said "No problem..if anoda phone U want I go buy am for U"..  ..so..she went to the market and priced the average phone...got back in hotmail and hit me..GBOAM:"$250!"  ...I clicked refresh as if dat go change the price but no deal....
...a few hours later I sent her the Western Union with a note attached to am:"NO BAFF WHEN YA ROOMIE'S FRIENDS ARE AROUND ANYMORE O!  "
Pa
|
PaJ, the phone sef fit cost pass like that for US o because most phones are made in Asian countries and they bring dem directly to naija instead of first having to go through the US. u no know say na latest the girl go buy? u think say na $30 dollar phone?
All these phone companies dem dey craze for real everyday dem go carry new one comot Nigerians dem go dey rush am, and the funny thing be say oyibo dem sef no dey use all those ones wey dem carry come for us. All of them done open regional offices for Naija finish.
The fastest growing business in Naija now must be phone marketing. Computer Village for Ikeja just opened about 3 years ago and you need to go there and see wetin dey happen now.