Quote:
|
Originally Posted by bluestocking
PaJ, the phone sef fit cost pass like that for US o because most phones are made in Asian countries and they bring dem directly to naija instead of first having to go through the US. u no know say na latest the girl go buy? u think say na $30 dollar phone?
All these phone companies dem dey craze for real everyday dem go carry new one comot Nigerians dem go dey rush am, and the funny thing be say oyibo dem sef no dey use all those ones wey dem carry come for us. All of them done open regional offices for Naija finish.
The fastest growing business in Naija now must be phone marketing. Computer Village for Ikeja just opened about 3 years ago and you need to go there and see wetin dey happen now.
|
...the same tin U wey U yan sef dey happen here..some people here go wan buy new phone simply becos the one wey dem get no fit cook rice like the newly advertised one....and can U believe some of these 'phones' cost like $800?

Granted some of dem na like laptop wey fit place phonecall but who cares?U should see the looks on the faces of some Naijababes after I don toast dem finish come whip out my apurukah phone to collect tel #..some of dem go dey stammer as if dem no wan give the # again ...

one even asked "Nna...where the hell is ya antenna?"

I tell am sey the yeye ting broke off after I use am jimmy my moto as I locked my car keys insai...the babe begin shake head..I wonder what for..the phone works just fine even widout antenna..shuo!
Pa