Quote:
|
Originally Posted by Mojames
okay bubu....i no go curse u again..... onye ara.... isi nkita... ewu awusa... nkpi.. anu ohia..... amadioha mabukwe gi ebe ino......
okay bubu....no money yabbing u here?.... 
|
..ok...ok..ok..enuff with the compliments..U dey make my head swell like dat boil wey dey ya backside..

U know?I'm giddy all over like dat time wey U start the ChickenPox Epidemic East of the Benue..

.....aaaawwwwwwww...my feri own luffly recently crawcraw-free portable Ikeregbe complete wiff teeth wey rezembu rake wey TownCouncil dey carry decorate town for curfew...

U know...I no go let the fact sey ya forehead rezembu Giant Blueband container and ya teeth skatta like corn bother me..I go still luff U..U hear?Omotofine.....go on soun ojare..luff wantintin...if U wan put foam insai ya jeans to make am look like sey yansh dey dia..shebi na ya biznez?Make haters hate..na U biko...

I don tell U..I no care wetin people sey..I find ya moustache shekshi....I don catch luffingitis O!!!
Pa