Interviews & Articles | Review Nigerian Movies | Discuss Movies | Movie Star Photos
Contact Us


Go Back   Nigerian Movies & Nollywood on Naijarules.com > Cinema Hall II > Nigerian Sports, African Sports, World Sports and Outdoor Life

Nigerian Sports, African Sports, World Sports and Outdoor Life All sports, including Hunting, Fishing, Hiking, Biking, Boating and extreme sports

Reply
 
Thread Tools Display Modes
  #1 (permalink)  
Old 05-17-2007, 02:53 PM
paj's Avatar
paj paj is offline
Naija Ruler!
 

Join Date: Jan 2005
Location: us
Posts: 20,141
My Mood:
Thanks: 3
Thanked 47 Times in 39 Posts
Angry Dear Mr Mourinho

Dear Mr Mourinho
....This na Pa J wey dey follo U yan so.Now..U fit no sabi me O..but na me be dat invinsible sideline jujuman wey dey do sideline incantation those dozen or so games wey una leave am till the last minute to score and win matches.Now...mai I confess,before U come Chelsea I been dey follo Arsenal before before ...but dem fokop and trade my boy Kanu so I vex come join una! I still like Arsenal too though but as una snatch title from Manure mouff di ting sweet me so teeeeey...I join! Becos....Manure na one team wey I hate from here to Kutuwenji! Dem arrongant,pompous,cocky and dat dia yeye manager don chew all the bazooka joe for England finish!I begin hate dem when Chelsea,with Babayaro and Gianfranco Zola wire dem 6-0 in 1999 and these vagabonds begin troway blow for wembley!O-Gini?Na which kin hooliganism be dis..dem no dey whip pesin na im Chelsea whip dem?Anyway..make we fast foward...2007...
...Mr Mourinho..I take God beg U...I know E early for xmas but please I take all my Oshoronga Mothers beg U..make sure U wire Manure some serious caning on Saturday abeg!I get like a dozen Manure shriners wey be my paddypaddy...extending from yanki to Nigeria wey ready to mock me from hia to Kingdom come if Manure win..abeg no let dat happen O!Abeg make U do dem like AC Milan do dem abeg!To celebrate di ting sef I don buy Agege bread wey go accompany dat English Tea wey I buy for E-BAY.This weekend na serious miliki weekend after we show Manure the reason why Kanda and real meat no be mate!
Pa
__________________
....Perception Is Everything....

Pa
Digg this Post!Add Post to del.icio.usBookmark Post in TechnoratiFurl this Post!
Reply With Quote
Sponsored Links
  #2 (permalink)  
Old 05-24-2007, 09:58 AM
amet13's Avatar
I dey keep my side
 

Join Date: Apr 2004
Location: GHANA
Posts: 5,020
Thanks: 2
Thanked 7 Times in 6 Posts
kai i just stumbled upon this thread, i sure say Mourinho no fit read am buti i know say God show am everything for dream
__________________
I'M TOO BLESSED TO BE STRESSED
Digg this Post!Add Post to del.icio.usBookmark Post in TechnoratiFurl this Post!
Reply With Quote
  #3 (permalink)  
Old 05-24-2007, 10:08 AM
Master Group
 

Join Date: Sep 2006
Location: Berlin-Germany
Posts: 1,455
My Mood:
Thanks: 68
Thanked 50 Times in 41 Posts
Pa J,you are way too funny abeg. So khaki and kpomo no be the same?
Don't worry God go do say Chelsea go show them peper.
Digg this Post!Add Post to del.icio.usBookmark Post in TechnoratiFurl this Post!
Reply With Quote
Reply

Thread Tools
Display Modes

Posting Rules
You may not post new threads
You may not post replies
You may not post attachments
You may not edit your posts

BB code is On
Smilies are On
[IMG] code is Off
HTML code is Off
Trackbacks are Off
Pingbacks are Off
Refbacks are Off


All times are GMT -4. The time now is 08:13 PM.


Powered by vBulletin® Version 3.7.3
Copyright ©2000 - 2008, Jelsoft Enterprises Ltd.
Search Engine Friendly URLs by vBSEO 3.2.0
Copyright Naija Rules!